Clearly, some people are single because they choose to be. They are
simply not interested in being in a serious relationship at this time in
their life. Others are single due to the circumstances of their lives.
They may have just gotten out of a meaningful relationship or have dated
relentlessly and just haven't found someone with whom they're truly
compatible. The point of this article isn't to stereotype all single
women or men or to put anyone in a box. However, for people,
particularly those over 30, who are looking for answers to the puzzling
question "Why am I still single?" here are some unconventional answers
that lie within.
I will write the reasons in pidgin English so it would flow as easy as can be.
1. DEFENSES
Many
people always dey find problems for wetin them dey call "inter-personal
relationships". With time and all the pains wey them find for those
relationships, them go come build wall to protect their heart. Most time
self, no be boyfriend, girlfriend dey cause, na the way them grow up.
If your mama or papa or person wey train you been dey show you oba, no
surprise if you dey single. The reason be say you don build up one kind
big wall, gidiga, and you go dey always suspect anybody wey show you
care and love. Na so so run you go dey run when you feel say person don
dey too show interest for your case.
Just open up yourself and comot all those fear if not, you go look for will of God tire, you no go see.
2. UNHEALTHY ATTRACTION
Because
of the fear and defense wey you been don take cover your heart before,
you go find yourself for bad relationship. You go see say you end up
with partner wey no dey even feel you at all. This thing sha no be your
fault, as I take talk am for the first reason, I go talk am again. When
you realize say person don too show you love, you go begin wan change
but e no easy. You go look your self for mirror dey talk say "I too
fine?" "You sure say him love me?"
Just loosen yourself, brother, sister, if no be now, na when? All your friends go marry leave you oo.
3. FEAR OF INTIMACY
I
know say many people go think say na Nairaland Spambot change this
thing to intimacy, for where. Na me write am like that. Many people dey
always talk am for their mind say them wan find loving partner but when
we come see as real love be like we go begin wonder. Why? Because of
those things wey you don dey imagine since wey you dey small be love.
You don too read romantic novels, watch enough Indian Bollywood films
and Naija jaga-jaga film to think say na so e be. Just chill, love dey
more complicated. No run because you think say love no be wetin you plan
am to be, flow with the tide.
A word dey enough o, make you no
begin meet prophets wey go chop you or chop your money in the name of
say you think say people dey follow you from village.
4. PICKINESS
This
one na the baba of all the yanings. Because of how we carry grow up,
how we dey take fear intimacy and how our defense strong pass kiri-kiri
maximum prison, we go begin dey do chose-chose. One of my female friends
tell me about one man wey dey follow am. Kai, she say the man dey drive
keke-napep (Miss Yuzedo) and although the man funny and dey caring, she
feel say him no get money. Naija girls, when them go ever realize say
no be all about the money? Na so she carry herself go look for other
people wey she feel say fit settle her needs. Where she end up? She end
up with men wey wan collect only kpekus and no just dey emotionally
attached to her.
No surprise if you see woman wey fine and never
marry upon say many men dey carry jeep come look for her. I just tell
you wetin dey happen behind those tinted screens.
5. LOW SELF ESTEEM
This
one bad gan. Many people want relationship wey go sweet their belle but
them dey always feel say nobody dey for this world wey go look their
face. Hiiaannnn... What non-sense. You never see mad woman dey waka for
road with belle before? Who give am the belle? Forget all those talks
about ritualists and look am from this concept. If man preek fit rise
for mad woman, what about you wey feel say you worwor? Next time you see
who you like, make that eye contact, show am love and gbosa, him go
propose to you. If you allow low self-esteem kill you, God go question
you for judgment day. Remember, Bible self say, "I am wonderfully and
fearfully created." The wonderful and the fearful ones know themselves.
Paint your face, wear your best smile if not you go die single and at worst self, worwor with no taste of real love.
6. FEAR OF COMPETITION
When
you no get self-esteem, na wetin remain? You go begin fear competition.
When you see person dey talk to your babe, na so your mind go dey beat
gbim, gbim, gbim. This thing don happen to many people, both man and
woman but na man own dey pain pass. Forget say the guy fit fine pass
you, your babe get wetin she dey see inside you. But ladies, if you
catch your boyfriend dey talk to another girl, just look for acid pour
am. Though I no support violence sha, if the babe fine pass you, just up
your game.
Ever wondered why your girlfriend catches you then decided to tease you with that sexy lingerie?
7. ISOLATION AND ROUTINE
As
you dey grow older, na so you go dey retreat further and further into
yourself. Nowadays self, women dey hammer pass man as them don sabi say
hustling dey pay wella. Whenever una come back from work, una go just
decide to eat, drink wine then sleep instead of going out to meet man. E
no cool at all, forget wetin that inner voice dey tell una. Marriage
fit no be by force but nature go always compel you to do wetin dey
right.
Burst that bolon-bolo wey you carry cover yourself, old age and being unmarried bad oo.
8. RULE-MAKING
This
one na im be the crux of the whole matter. As person start to dey grow
old, dey hammer, dey relax, na so them go begin create rules and
regulation. Imagine say you meet woman, she go first size then bring out
one kind long list of rules carry give you. Omo, na old age go hold you
o. All those rules wey you dey make, dey speak phoney join go enter
devil backyard. "My man must be this, he must be that" or "My woman must
know how to do this, most know how to do that." Make una dey there dey
make the rules, na singleness una go dey court till trumpet go sound.
Rules na to govern people o, but sometimes, that same rule fit enslave you.
No comments:
Post a Comment